https://www.bbc.com/pidgin/articles/cgq2l99vvnxo
https://archive.is/l7Umd
Egide Irambona, wey think say e bin contract mpox from one friend, fit don pass am to to im wife
Mercy Juma
Role,BBC News, Bujumbura
4 hours wey don pass
Egide Irambona, 40, siddon bare-chested on im hospital bed, next to di window, for one treatment room wey e dey share wit two oda men.
Di rays of di evening sun dey shine above Burundi main city, Bujumbura, filter in. Im face, cover wit soft light, full of blisters. Im chest too, and im arms.
“I bin get swollen lymph nodes for my throat. E bin dey so painful I no fit sleep. Den di pain go down dia and den e move to my legs,” e tell BBC.
Oga Irambona get mpox.
E be one of di more dan 170 confirmed cases wey dey recorded since last month for Burundi. One of di poorest kontries in di world, e border di Democratic Republic of Congo, di epicentre of plenti recent mpox outbreaks, wey don lead to at least 450 deaths and 14,000 suspected cases so far dis year.
For Burundi, e neva get recorded deaths and e neva dey yet clear how deadly di current outbreak - of one new strain wey dem dey call Clade 1b - dey sake of say no enough capacity to carry out testing for di affected areas.
However, e don dey declared global health emergency sake of fears say e fit spread quickly to previously unaffected kontries and regions.
Dis na Oga Irambona ninth day of treatment for di King Khaled University Hospital. One way wey di virus dey spread na through close contact wit pesin wey dey infected and e be l;ike say e pass am on to im wife.
She also dey looked afta for di same facility.
“I bin get one friend wey bin get blisters. I think I get am from am. I no know say na mpox. Thankfully our seven children neva show any signs say dem get am,”Oga Irambona tok, im voice trail off.
Dis hospital for Bujumbura na home to one of three mpox treatment centres for di city.
Fifty-nine of di 61 available beds dey occupied by infected patients – one third na under di age of 15 and, according to di World health Organization, children na di worst-affected age group hia.
Odette Nsavyimana na di doctor in charge for di hospital and tok say di number of patients dey increase.
“We now dey set up tents outside.” Na three dey so far – one for triage, one to hold suspected cases and one to take confirmed cases bifor dey fit dey transferred to di wards.
"E dey tough, especially wen di babies come. Dey no fit stay alone, so I need keep dia mothers hia as well. Even if dey no get symptoms… na one kind tough situation,” Dr Nsavyimana tok, her voice wrap up by her protective face mask.
Burundi now dey see rise for mpox cases.
"I dey worry about di numbers. If dey keep increasing, no capacity for us to handle dat.”